Posts

Showing posts from March, 2019

International Women's day:: This na three woman wey do. Make Nigeria proud well well for the word

Nigeria no be just any country dem fit just put for one side for all things dem dey do, make we talk for acting, sport, music we be dere baba for all dis side, even for the word cup wey finish for last year, country wey we meet sef no say no be play play Soo today we go dey put eyes for ladies wey don work wella with there power to make we wey be Nigeria yanga well NO 1 Genevieve Nnaji This woman na one no 1 inside actress for Naija wey don start her career since 1998, we see am say  that don tey for the work, Genevieve don build herself for industry wey be say nobody fit shake am https://Twitter.com/geneveivennaji1

Our New page for pidgen news

Image
Pidgen news logo We create this page soo people go fit understand clear clear the news as he dey hot for street and for Naija, no be say na everybody no dey hear the English ooo but most people dey enjoy the original pidgen wella as the thing dey go. We go dey bring am to you as you want am, no forget to follow us for FACEBOOK  soo u go dey enjoy am shapally. Thanks